Luke 16
1 Jesus tell im followers another story. "One rich man hire somebody to watch over all im money. People tell the rich man say this worker dey waste everything."
3 The worker ask imself say, "Wetin I go do now? My boss don pursue me. I no get power to dig ground. Shame no go let me sit down for street dey beg."
5 E call everybody wey owe im boss money come. E ask the first person say, "How much you owe?"
8 The boss come find out. E surprise well-well. E praise the wuru-wuru worker because e use sense! People wey love darkness get sense for their own world pass people wey live for light.
13 "You no fit work for two oga. You go love one and hate the other one. You go hold one tight and push the other one throway. You no fit work for God and money at the same time!"