Luke 17

11 Jesus continue dey walk go Jerusalem. E walk pass between Samaria and Galilee.

14 Jesus look them. "Go show unaselves to the priests!" As they dey walk go, their skin come clean.

15 One man see say im skin don heal. E stop. E turn around run back go meet Jesus, e dey shout praise God as loud as e fit.

20 Some Pharisees ask Jesus, "When God Kingdom go come?" Jesus talk say, "God Kingdom no dey come the way wey eyes fit see."

22 Jesus tell him followers say, "Time dey come when una go wish say una fit see just one day of the Son of Man. But una no go see am."