Genesis 47

1 Joseph go meet Pharaoh. E say, "My papa and my brothers don come from Canaan! Dem bring dia sheep, dia cows, and everything wey dem get. Right now dem dey for Goshen."

11 Joseph give in papa and brothers land for Egypt. E put dem for di best part. E be di land of Rameses. Pharaoh say dem fit get am.