Genesis 48
1 Small time pass. Den pesin come bring news give Joseph. "Your papa dey very sick!" Joseph carry im two pikin, Manasseh and Ephraim, con go meet am.
13 Joseph put Ephraim for im right side, face Israel left hand. E put Manasseh for im left side, face Israel right hand. E bring dem come near.