Genesis 46
1 Israel pack everything wey he get. He enter road. He stop for Beersheba. Dere he kill animals give the God of his papa Isaac.
5 Jacob stand up from Beersheba. His sons carry am put inside the carts wey Pharaoh send. Dem put dia small pikin dem and wives inside too.
28 Jacob send Judah go front make e find Joseph. Judah go show dem di road to Goshen. Den di whole family reach Goshen.
29 Joseph arrange in chariot. E run go meet in papa Israel for Goshen! Immediately e see am, Joseph just hold in papa neck. E cry and cry and cry for long time.
31 Joseph tell in brothers and everybody for in papa house, "I go go see Pharaoh. I go tell am say una don come from Canaan to stay with me."