How E Start

Natin. No light. No ground. No sky. Na just deep, black wey no get end. Then God open im mouth. "Make light dey!" Light come out from nowhere and fill evrywhere! God come separate di light from di dark. E call di light Day and di dark Night. Di very first day.

God come talk again on top di water. Dat same time, di waters tear apart! Some stay for under. Some go up high. Between dem, God open one big wide space. E look di air and di blue for up and call am Sky. Di second day don finish.

Long time before any person breathe air, God don already get family. Im sons full heaven. Dem watch am shape sometin wey be new, sometin wey none of dem don see before. God spread di earth with im own hands come put di stones for place. Im sons no fit hold am. Dem shout! Dem sing! Joy pour out of...

Gen 1:1