Luke 20
9 Den Jesus tell di people dis story. "One man plant grapes. He rent di farm give some farmers den travel go far place for long time."
10 "When time reach to harvest di grapes, he send one servant to go collect him own share. But di farmers beat di servant, send am back with empty hand."
13 "Den di owner think say, 'Wetin I go do now? I go send my own dear son. Dem go respect am.'"
20 So dem dey watch am well. Dem send spies wey pretend say dem want learn. Dia plan na to catch Jesus make he talk something wrong so dem go fit hand am over to di Roman ruler.
23 Jesus catch dia trick. "Why una dey try to trap me?" he talk.