Luke 19
2 One man wey dem dey call Zacchaeus live dere. Na him be di oga for tax office for di whole area. Money plenty for e house.
5 Jesus reach di place and look up. "Zacchaeus! Come down now! I need to stay your house today."
7 Di crowd start to complain. Dem say, "E go eat with sinner."
8 Zacchaeus stand up straight and talk to Jesus. "Lord, I go give half of evrytin wey I get to poor people. If I don steal from anybody, I go pay dem back four times."
9 Jesus say, "Today, God rescue don come dis house! Dis man na true son of Abraham."