Luke 24

1 Very early Sunday morning di women come back to di tomb. Day just dey break. Dem bring di spices wey dem make.

4 Dem stand dere dey shake. Dem no know wetin to tink. Dat same time two men appear near dem! Deir clothes shine bright like lightning!

13 Dat same day two of Jesus followers walk go one village wey dem dey call Emmaus. E far from Jerusalem like seven miles.

18 One of dem name na Cleopas. He reply am. "Na only you for Jerusalem never hear wetin happen dis past few days?"

25 Jesus tell dem. "You no dey tink straight! Your heart slow to trust wetin di prophets talk.