Luke 22

7 The day come when dem must kill the Passover lamb. Na dis day dem dey call Bread Wey No Get Yeast.

12 "E go take una go upstairs and show una one big room. Everything go dey ready. Prepare the food for there."

14 When time reach, Jesus sit down for table. In twelve apostles sit down with am.

19 Then e carry bread. E thank God for am, tear am to pieces, and give dem. E say, "This na my body. I dey give am for una. Do this to remember me."

20 After the food, e carry the cup again. "This cup na the new agreement wey dem seal with my blood. Dem dey pour am out for una."