Luke 13

1 Dat exact time, some people rush come meet Jesus. Dem carry news. "Pilate kill some Galileans! Right when dem dey give dia offerings! Dia blood mix with di blood for di altar!"

4 "And those eighteen people wey di tall building for Siloam fall put. Dem all die flat. Una tink say dem bad pass all di other people for Jerusalem?"

10 One Sabbath day Jesus stand up dey teach for inside dia meeting place.

14 Di man wey dey in charge face turn red. E shout for everybody. "We get six days for di week to work! Una won make e heal una? Make una come den! Not on di Sabbath!"

18 Jesus ask dem, "Wetin di Kingdom of God look like? Wetin I fit show una?"