Genesis 15

1 Later Yahweh follow Abram talk inside dream. "Make you no fear, Abram. I dey here. I be your shield. I dey keep you safe. I be your big reward. I pass everything!"

4 Yahweh answer am. "No! Dat man no go get your things. Na your own pikin go get am. Pikin from your own body!"

9 Yahweh talk sey, "Bring me cow, goat, and ram. Each one must be three years old. Also bring dove and one young bird."

11 Big birds come down from di sky! Dem want chop di meat. Abram wave im hands. E drive dem comot.

12 Sun go down. Heavy sleep catch Abram. E no fit open eye again. Heavy and scary darkness cover am.